Home As e de hot Elderlies suppose dey chop special food – Nutrition

Elderlies suppose dey chop special food – Nutrition

196
0

Nutrition experts don too talk about the matter say elderlies suppose dey chop food wey dey give ogbonge nutrients, dem still play di tape for man dem say poor nutrients fit make dem mental and physical health yawa.

The nutritionist still add jara say na yawa food dey make dem body and health dey carry face.

E still occur say na bad diet for dem grani dem dey make dem dey diminish for weight, disorientation, light-headedness, altered brain functionand loss of appetite.

E dey reported say e get some small small health risk wey oldie dem fit dey suffer from poor diet wey be weakened immune system, lowered energy levels and chronic health problems wey fit be type 2 diabetes, high blood presure, heart disease, stroke and osteoporosis.

Former Director of Nutrition Services for Ondo State, Mr James Olodeye plus Chief Executive officer Evergreen Health and Social Care International, Mrs Yemisi Solanke put extra ontop the mata, say as body dey grow nutritional needs dey change with am, dat mean person gats dey change as em dey take chop before the mata chop am.

Oloyede been drag the mata as em dey talk to our person say dietry choices for grani dem gast dey change make dem no go evaporate enter bone mode.

Im talk say if dem no dey used to the nutrition change as dem body dey grow dem fit enter malnutrition level.

E show korokoro unto no be say dem no go fit do dem normal dieting, but say d diet gats dey modified make e suit changes for the digestive system for the elderly.

Anyways e add say, old people dem gats dey try avoid raw foods or undercooked eggs cause as dem don dey old sickness fit dey catch dem sharp sharp.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.