Di MakeOurHospitalWork Campaign don get better result as ogbonge politicians don dey increase their jinja to support work wey go helep make dem hospitals work. Di Candidates of Labour Party wey dey drag di Chair of Senate for Ebonyi South Senatorial Zone, Hon. Linus Abaa Okorie don buy 200 copies of di tear-rubber book by Dr Laz Ude Eze – How to Make Our Hospitals Work. Hon. Okorie wey be former two-term member of House of Reps talk say he go share the books among community leaders across all the 57 wards inside 5 LGAs of Afikpo North, Afikpo South, Ivo, Ohaozara and Onicha, of Ebonyi State. He talk say im go use im office, if he wins senate election for 2023, to work wella with communities and TalkHealth9ja to improve primary health care.

Im party man wey dey drag chair of House of Reps for Ohaozara-Onicha-Ivo Federal Constituency, Chief Nkemkanma Kama talk say he wan make every health centre dey work for im constituency. He also bought 100 copies of di book to distribute among community leaders across im constituency.
Both Hon. Okorie and Chief Kama bin show face wella for di official launch of di new book inside Abuja, and project dissemination meeting wey TalkHealth9ja organise with di MakeOurHospitalWork Campaign. Dem say no be only dem go gain knowledge wey di author of di book don write down based on experience.
Medical experts dey dey di event bin give tuale to the candidates wey show interest towards improving health care. Tori wey reach us show say people of Ebonyi South dey jollificate about dis mata, as dis na di first time wey dis kind thing dey happen. TalkHealth9ja dey hope say other politicians go do likewise because making our hospitals work na everybody’s responsibility.

