Home As e de hot Collabo with NAFDAC go help us – PSN

Collabo with NAFDAC go help us – PSN

163
0

Di Pharmaceutical Society of Nigeria don beg make National Agency for Food and Drug Administration and Control collabo with dem so dey go fit activate federal and state task force wey go work to clean drug distribution channels for di country.

Di Presido for di society, Cyril Usifoh, been drop dis proposal when dem do courtesy visit to di Acting Director-General of NAFDAC, Monica Eimunjeze.

He yan say di palava wey dey di drug distribution channel dey worse everyday even tho e don reach 35 years when dem first enact The Fake Drug Act was first enacted as decree 21 of 1988.

Di Presido tok say di Pharmaceutical Society of Nigeria dey when dem do proceedings for NASS a few weeks ago as dem try adjust di existing Fake Drug Act but dey believe say na only collabo with dem and NAFDAC go solve dis mata. He also yan say dem suppose put eye for challenges wey dey come when dey wan destroy expired drugs.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.