Home As e de hot China don dey relax coro policy

China don dey relax coro policy

226
0

Authorities for China’s financial hub of Shanghai go comot all di testing protocol wey people suppose do for coro as di country don dey slow down día coro policies as we-no-go-gree full everywhere for di country like dem never see before.

Plenty cities don dey comot dia restrictions after di country people just vex for all di serious protocol wey dem pack for coro.

People for Shanghai no go need 48-hour negative test result so dem go fit use public transport and enter outdoor venues such as parks and tourist attractions.

No be only Shanghai, but other plenty cities like Beijing, Tianjin, Shenzhen and Chengdu, don cancel all dia testing law for public transport.

Beijing don also dump di rule wey person go need confam registration before dem buy cold and fever medicine.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.