Di Nigerian Medical Association, Lagos State chapter, don reveal say na 507 medical doctors wey dey practise for di state don japa to United Kingdom in less than 24 months because say Naija work conditions no favour dem.
Di Chairmo for di association, Dr. Benjamin Olowojebutu beg say make Federal and state governments start to dey put eye for dis mata of brain drain for di health sector because na big palava and e fit make medicine disappear for di country.
Olowojebutu yan say di way doctors dey take japa especially for Lagos State dey make am cry and dey suppose dey take di mata as emergency so dem go find solution quick quick.