Home As e de hot You fit enter gbese if you wan get belle after 50 years...

You fit enter gbese if you wan get belle after 50 years – Expert

106
0

One fertility expert, Dr. Faye Iketubosin, don advise women wey don pass 50 years and wey dey find fertility treatment to make sure say dia health dey bam before dem start di treatment.

Di IVF expert reveal say fertility treatment especially for women wey don pass 50 and no too get strong health dey very risky because according to wetin experts tok, woman wey don pass 35 come carry belle na geriatric pregnancy dem dey call am, even tho na advanced maternal age dem dey call am now.

Di American College of Obstetrics and Gynaecology for dia side come tok say many people don dey get high blood pressure when dem carry belle now more than before.

One article wey Healthline publish online between 2000 and 2009 show say number of people wey get belle come dey suffer high blood pressure increase by 69 percent and e dey worse for African American people because dia own increase by 87 percent.

Di article still show say higher risk like preeclampsia (di kain blood pressure wey dey happen for pregnancy and e fit kill), gestational diabetes, ectopic pregnancy (when the egg dey attached outside of the uterus), higher risk of needing a caesarean delivery, miscarriage, and stillbirth fit happen for woman wey carry belle for her 50s .

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.