Home As e de hot We wan make people stop drug abuse – PSN Kwara

We wan make people stop drug abuse – PSN Kwara

121
0

Di Kwara state chapter of Pharmaceutical Society of Nigeria (PSN) don do one-day sensitisation campaign against drug abuse, that one na to make man pikin sabi about the fight against drug abuse.

Na so dem waka from one street to another for Ilorin.

For sideline of the campaign, Mr. Adejuwon Otelaja wey be the chairman of PSN been yarn say dem organize the campaign to take mark 2022 week for the state.

Di oga been talk say e don dey necessary to campaign against drug abuse and other substances wey di law been forbid because of the danger wey e carry for the future of the nation and also the people wey don soak dem body for inside this bad thing.

Oga Otelaja yarn say the society dey hold hands together with NDLEA come dey fight drug abuse by di way dem dey take open public eye to see di danger wey follow drug abuse.

The United Nations Office On Drugs And Crimes for dia 2022 yearly report, been rate Kwara state say na 13% of dia population dey take drugs.

Otelaja con confirm say the di people wey dey use di drugs na to take cool man wahala and stress.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.