Di National Agency for Food and Drugs Administration and Control don yan say dem dey try to reach World Health Organisation Maturity Level Four certification.
Dey tok say di certificate go carry pharmaceutical products wey di country produce drop am for better level for di world market.
Di Director General of NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye yan dis one when dem open di NAFDAC office for Ilorin, Kwara State on Friday.
She point out say di agency go continue dey develop as dem been get dia Maturity Level 3 for di WHO Global Benchmarking Tools inside March 2022.
Adeyeye also twale give dia workforce and dia Governing Council say na dem make dia achievement possible.