Home As e de hot We still dey ontop health mata wey dey worry naija people –...

We still dey ontop health mata wey dey worry naija people – WMA Presido

109
0

Di presido of the World Medical Association Dr. Osahon Enabulele don yarn again about im commitment to handle health mata as e dey affect Naija and other African countries dem join di world.

Dr Enabulele na im give this assurance as im visit di Edo state governor Godwin Obaseki inside the government house for Benin.

Im tok say discussion dey waka underground with plenty physicians for different parts of the world concerning how to make health systems beta for undeserved community wey include Naija and some other African countries.

Di WMA presido been observe am say the medical people all over the world dey do everything possible to take stop disease wey dem dey call brain drain in a way wey be say na win-win.

As im take happiness dey thank the state government for the way dem tanda near am gidigbaa for Berlin when im dey do inauguration, im also thank governo obaseki for the im take send im deputy comrade philip shaibu to rep am .

To answer back Obaseki praise Enabulele say im dey proud of im remarkable achievement, come again advice say make im use this im time for office take tackle the brain drain disease the medical personel and other workers for health sector .

The governor also advice say make Enabulele develop solution wey go work wela con give positive impact for health sector both for local or international.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.