Home As e de hot We need to empower young doctors – WMA

We need to empower young doctors – WMA

238
0

Di Presido of the World Medical Association, Dr. Osahon Enabulele, for di first International Junior Doctors Network Conference wey happen for Kuala Lumpur, Malaysia on Saturday, don beg make medical people dey support and empower young doctors for di field.

Dr. Enabulele say di everyday case of bullying, harassment, and overwork wey junior doctors dey face dey vex because e dey lead to burnout of di doctors both physically and mentally.

He drop press statement say because mentorship programs no dey happen for di medical field again, better channel no dey to help di junior doctors come up again as e dey push some commot from medical line to look for other things dem go do and that one sef dey get serious impact for di healthcare delivery.

Di presido wey remind physicians say dem need to commit to di Physician’s pledge and the revised International Code of Medical ethics, also come assure junior doctors say WMA dey committed to help dem develop for dia careers and dem go make sure to get to di root of wetin dey cause violence for dia workplace.

Di WMA Presido don enter Geneva make him go sign Memorandum of Understanding with di Director General of the World Health Organisation, Dr.Tedros Ghebreyesus.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.