Di Lagos State Government through dia Ministry of Health don beg make collabo dey to fight breast cancer.
For Road Awareness Walk wey Ministry of Health collab with one pharmaceutical company, Novartis, to organise for Lagos, di Permanent Secretary for Lagos State Ministry of Health, Dr. Olusegun Ogboye yan saydem dey do everything dem fit, like to raise necessary awareness, sensitize di people, to gather money help support treatment service wey go save lives, to research and even do rehabilitation for people wey get breast cancer.
Ogboye also yan say many people wey don kpai from breast cancer dey for low- and middle-income countries as most of di women no know until e late and na mainly because awareness no reach día side plus late detection, and plenty roadblock dem dey face for health sector.He yan say if dem find di disease dearly, e dey easier to manage and treat am.