Cross river state government don swear say dem go sanction health care facilities wey dey charge pass N3k per delivery.
The director-general for cross river primary health development agency, Dr Janet Ekpenyong, been yarn this mata as dem been dey hold one intergrated meeting with PHC Ward Focal Persons join the state Basic Healthcare Provision Scheme for Calabar.
Ekpenyong been yarn say the agency don collect complain say some PHC dem dey use big eye collect reach N10k.
She talk say 196 PHCs way dey the state, e sure pass 130 wey don dey accredited via di Cross River Basic Healthcare Insurance Scheme, plus say as di scheme dey grow, other PHC dem go dey accredited too.
She con warn officials for PHCs say, as the mata be, their way fit make client put or commot body for their facilities.
Mr. Godwin Iyala, Director-General for Cross River Basic Healthcare Provision Scheme, talk say the scheme dey important for the health of women way carry belle follow up the ones way dey ready to born.
As im take talk am, im don put call say 50 lapi don nearly touch down give the PHCs accredited for the Basic Healthcare Provision Scheme.
The Director General also talk say dem organise the programme for service delivery, plus say the agency no go allow irregularities and mumu behavior for PHCs.
The Special Adviser to the Governor on Health, Dr. David Ushie, beg officials make dem no dey para for client, cus say patience, satisfaction na the only key to success of the scheme.