Home As e de hot We go deworm all primary school pikin for Kwara – Health ministry

We go deworm all primary school pikin for Kwara – Health ministry

197
0

Di Department of Neglected Tropical Diseases, Ministry of Health in Kwara don start to deworm all di primary school children wey dey di 16 local government areas for di state.

Di Governor wife, Dr. Olufolake Abdulrazaq, when she dey do carry go for di Queen Elizabeth Secondary School, Ilorin on Thursday yan say worm infestations dey very common for di tropics and subtropical areas and di one wey dey more for di sub-Saharan Africa, the Americas, China, and East Asia na schistosomiasis wey be one of di oga kpata kpata of worm famly and dem dey under di Neglected Tropical Diseases group.

Di governor wife, wey Dr. Raji Razaq, the Kwara Commissioner for Health represent say Schistosomiasis na very serious acute chronic disease wey parasites dey cause and symptoms e dey carry come fit be fever, chills, cough, muscle aches, abdominal pain, enlarged liver, blood in the stool or blood in the urine, and difficulty passing urine, etc.

Abdulrazaq come still explain say di disease fit cause weak body system come still scatter defense wey di body get and e go carry di body enter serious sickness and plenty palava even death.

She come still assure di people say di state government go continue to dey put di health of di people first and make sure say dem fight NTDs with di same strength dem use to COVID-19 and combat malaria.

Di governor wife still twale for di partners and stakeholder agencies like Sightsavers and Global Fund say dem do well as dem dey committed to make sure say di people for di state get good health.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.