Home As e de hot We go create table to boost nutrition for di state – Gombe

We go create table to boost nutrition for di state – Gombe

146
0

Di Secretary to Gombe State Government, Professor Ibrahim Njodi, don reveal say government dey arrange document wey go make Ministries, Departments, and Agencies to create Nutrition table so dem go fit boost nutrition mata for di state.

Di SSG yan say dis one go help show say government dey committed to boosting mata wey concern nutrition for di state.

Njodi been tok dis one when di disclosed dis when di leaders and members of Accelerating Nutrition Results In Nigeria (ANRiN) been visit him office on Friday.

Reports dey show say malnutrition na one of di deadliest killer for children wey never reach 5 years for Gombe State.

Di SSG no hide him joy as him dey tok of di success wey dem don get with di implementation of di Nutrition Project wey di World Bank dey support for di state.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.