Di Lagos State Government wan team up with NGO, Global Emerging Pathogens Treatment Consortium make dem organize 3day discourse for Health and Biosecurity for Lagos Nigeria.
Di Lagos State Commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi yan say di conference go be di 4th one wey Lagos don organize with GET and e go be di 8th one wey go happen for West Africa and African continent so dem go help build biosecurity roadmap and African go get upgrade for dia fight against pathogens wey dey cause trouble.
Di Conference wey dem call 8th African Conference on Health and Biosecurity with di them, “Strengthening Health Security and Mitigating Biological Threats in Africa” go happen for di Civic Centre, Lagos between Wednesday 2nd and Friday 4th November 2022.
Prof. Abayomi point out say e dey very significant say dem dey host am for Lag because di state na low-line coastline city wey get plenty people and naim be di commercial hub for sub-Saharan Africa as dis conference go carry plenty people for different parts of di world wey be experts for di matter bring Lagos.
He reveal say di state dey very open to biological threats so e dey very importankpa say di state government go upgrade dia strength and still build better infrastructure wey go dey strong enough to fight dangerous pathogens wey dey raise head.