The world health organisation, WHO, don gum body with Yobe government come organise 2 days training for health promotion officers via info-medic.
Di state co-ordinator for WHO, Dr Nuhu Ningi wen im been dey address people wey come di training for Damaturu yarn say the training dey necessary to take empower health promotion officers dem for the 17 local government areas inside the state.
The news agency of Nigeria been report say informedic na quick-quick and farreaching spread of infomate wey correct plus the one wen no correct via some thing like disease.
Informedic also mean overplenty amount of informate wen no dey allways dey trustworthy , con spread fast go block way for beta solution.
Dat kain informate dey join lie-lie and tory wey miss road inside digital and physical environment wen disease don kukuma break out.
The WHO co-odinator las-las yarn say training of health promotion officer dem, e dey apt, for the prevention and prompt response to the outbreak of curtail morbidity.
Ningi kowashiate say correct and ogbonga informart dey very important in the transformate and how dem go dey approach situation especially wen disease don break out for inside community.
Dr Kundi Machina, the executive secretary yobe primary health care management board con twale give WHO via the way dem take gum body follow state government.
Im kukuma yarn say for the end of the training workshop, participant go don sabi dey give beta and chachala update on riski-riski communication on ogbonga beta way to take curtail different-different form of epidemic disease dem inside the state.