Di Commissioner for Agriculture and Food Security for Edo State, Mr. Stephen Idenhere, don give order make dem close Kara Abattoir wey di state get for Eyaen, Uhunmwode Local Government Area of the state.
Idehenre been shock dem with visit, come see say di place dey yama yama and man pikin no suppose touch or even chop anything from there.
E come vex for di oga dem wey dey manage di place, say make dem lock up di place till dem ready to dey keep am clean and if anybody try go near di place, him go show am pepper.
Di commissioner yan say di ministry don write plenty letter give di people wey dey manage di abbatoir but dem do eye like dem no see am.