Home As e de hot VVF plenty for Cross River – Doctor

VVF plenty for Cross River – Doctor

160
0

Di Oga Head of the Vesicovaginal Fistula Unit for General Hospital, Calabar, Dr. Etim Ayi, don open up say teenage pregnancy na di main cause of VVF for Cross River.

Ayi been yan say increase for pregnancy for small small girls wey dey between 12 and 14 years dey very bad because e dey cause serious health wahala.

Reports show say VVF na opening wey dey happen between the bladder and wall of the vagina and e go come make urine dey leak out of di vagina.

E fit dey very small but if di opening big, di urine go dey rush out and if dem no treat am e fit cause serious bacterial infection wey fit lead to sepsis – dangerous condition wey fit lead to low blood pressure, organ damage, or even death.

Di condition dey very uncomfortable and na one of di most annoying problem wey dey for gynecologic and obstetric procedures but dem fit still reverse and repair am through surgery so di survivors go live normal lives.

Di most common things wey dey cause VVF na obstructed labour, early marriage, poverty and women’s limited control over the use of family resources.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.