Di Minister for Health, Dr. Osagie Ehanire, don beg make people join hands again so dem go stop spread wey HIV and AIDS dey spread by 2030.
He tok dis one to help mark di World AIDS Day as e dey always happen for December 1, 2022, wey be international day for di world wey dem dey use teach people about AIDS as e speed from HIV and also to remember di people wey di disease don kpai.
Di UN member states dey use am to know wetin dem don do to try comot HIV / AIDS and to come plan for di next year.
Di minister for health, come beg say make government wey dey all di level especially state upgrade how dem dey fight HIV.
Dr. Akudo Ikpeazu, the Director, National AIDS and Sexually Transmitted Infection Control Programme (NASCP) wey represent di Ministry of Health, Ehanire, yan say Naija dey very high for HIV response as 98 percent of people don know whether dem get am or not already and e dey help di infection to dey reduce.
He still come seriously point out say dey go need stop all di inequalities wey no dey gree access to prevent, come treat HIV.