Home As e de hot Try dey chop balanced diet for your health – Nutritionist

Try dey chop balanced diet for your health – Nutritionist

174
0

One Nutritionist wey be Regina Sodu don beg naija people make dem dey chop better healthy food say e no too cost to chop am.

Sodu yan dis one when she dey deliver paper on importance of nutrition for di 2022 World food day wey di Small-Scale Women Farmers Organisation of Nigeria, Gombe chapter collabo with di Ministry of Agriculture and Animal Husbandry, Actionaid Nigeria, and Hope Foundation for the Lonely to organise.

Dem organize di event make dem use am show food items wey SWOFON members from di 11 Local Government Areas of Gombe State produce, both di ones wey don dey processed and di ones wey still dey fresh.

She point out say to eat healthy mean say person gats know wetin to chop, how to chop am and when to chop am and make government invest for agriculture so food go boku for di country.

Di Organisation also point out say Gombe State Government need to make sure say dem implement di budget wey di Ministry of Agriculture and Animal Husbandry allocate for smallholder women farmers.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.