Home As e de hot TB cases don dey increase again – WHO

TB cases don dey increase again – WHO

133
0

World Health Organisation yan on Thursday sayTuberculosis case numbers for di first time for more than 20 years been increase last year because of COVID-19 pandemic wey scatter access to diagnosis and treatment.

TB land gidigba again after years we e look like e don commot, come kpai more than 1.6 million people for 2021 wey be 14 percent increase for 2 years as e kpai like 1.5 million people for 2020 and 1.4 million for 2019.

Tereza Kasaeva wey be di director of the UN health agency’s global TB programme yan say now na critical moment to fight di disease.WHO tok for dia annual report say na like 10.6 million people fall sick with TB for 2021 wey be 4.5 percent increase against 2020.

Dey also reveal say most people wey been get TB last year dey for southeast Asia (45 percent), Africa (23 per cent) and the Western Pacific region (18 per cent).

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.