Home As e de hot Stroke no be old people disease again – NGO

Stroke no be old people disease again – NGO

210
0

NGO wey be di Stroke Action don yan say awareness suppose dey for signs wey stroke dey carry come and also sharp quality treatment because stroke no be old people disease again, even young people dey suffer am bad.

Di Chief Executive for di NGO wey also be Nurse, Rita Melifonwu, been yan dis one wen dem do World Stroke Day wey be chance wey global stroke community get to increase awareness on wetin stroke dey do and how e take dey affect people.

Dey also tok say e dey importankpa to reduce burden wey stroke dey carry come as dem dey tell people about di risk factors and also opportunity dem get to ask people wey dey power make dem increase stroke prevention, access to acute treatment and support for survivors and caregivers.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.