Home As e de hot Shine your eyes! Deadly drug wan enter naija market – NDLEA

Shine your eyes! Deadly drug wan enter naija market – NDLEA

157
0

Di National Drug Law Enforcement Agency don find out plan wey some people get to bring in bad drug wey dem dey call Fentanyl to naija market.

Di Oga Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi been reveal say Fentanyl dey 100 times stronger than Tramadol and that e go cause serious damage for di youths if dem take am as di cartel dem want.

Di agency yan say dem dey do everything to make sure say dem no allow dis drug wey dey responsible for more than 70% of overdose deaths plus plenty overdoses wey dey happen for di US, enter naija.

NDLEA tell naija people make dem no worry because dem don put eye and assets to many places to make sure say dem fish out those people wey dey plan dis evil.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.