Home As e de hot Polio mata dey reduce! We dey do well! – WHO

Polio mata dey reduce! We dey do well! – WHO

145
0

World Health Organisation don yarn say e sure dem die say the global effort wey dem get to end polio don sure pass 99.9% decrease for polio since 1988.

Dr.Matshidiso wey be WHO regional director for Africa open this mata as dem dey mark 2022 World Polio Day, say 20 million children life don dey saved from disability as dem still dey walk Gara Gara.

Polio day dey open body make dem show global efforts towards a polio-free world, as dem wan honor dem wey e be say gallant no commot body for the fight to sweep polio.

The Theme for this year wey be, “World Polio Day 2022 and Beyond: A healthier future for mothers and children”, kick-off as WHO, Rotatory International, and Polioexerts been dey yarn for geneva as dem go take continue extra collabo give polio hot hot.

UN body don note am say WHO, don loud am say dem dey successful as dem shut down 32 outbreaks in 10 counties for the end of the first quarter for 2022. But as mata be, dem still gast shine eye as outbreaks still dey for ground.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.