Ontop the hundredth episode of di bodi mata Tv show wey dey happen every Tuesday for Africa Independent Telvision, sabi person for human resources, JT Oshoke don yarn say na where dey safe for employees to work na eim dey make dem produce better result.
Mr. Oskoke, still talk say, say person no well no be only when him dey suffer from headache, fever or other nyamanyama diseases.
Him talk say plenty employees no dey fit get result because say dem oga no dey give dem breathing space plus opportunity to take breaks, rest to take pay more attention for dem job.
Watch the video below for the full tori: