One Non-Governmental Development Organisation, the Mission to Save the Helpless, and another philanthropic organisation, the ENDfund, don dey support Ondo State Government to help solve Neglected Tropical Diseases for di state.
Di organisations been dey shout say NTDs dey increase anyhow for di state but dey go still dey support government.
As dem do opening for a free hydrocelectomy surgery and management of lymphoedema for Ondo people for di General Hospital, Idanre, di Executive Director for di MITOSATH Dr. Francisca Olamiju, reveal say more than 6 million people don collect better treatment from di organisation since 2015 for di state.
Di MITOSATH boss wey send her represent, senior programme manager for di organisation, Mrs. Ijeoma Achụ, yan say na di Ondo State Primary Health Care Development Agency been join hand with MITHOSATH and EndFund to organise di free surgery.