Home As e de hot No be your fault say you get Vitiligo – Experts

No be your fault say you get Vitiligo – Experts

178
0

Experts for skin don yan people we get vitiligo make dem close dia ears to anything wey people dey tok about dem because di condition no dey spread to people and e no transfer through blood and make dem know say di condition no be día fault because dem dey very normal, just dat día skin color change.

Di dermatologists explain say Vitiligo dey happen when di skin no get coloration/pigmentation or when e don reduce because say di melanocytes wey suppose colour dị skin no dey and e go come make di areas white for di body.

Di expert wey be Professor for Dermatology, Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Olayinka Olasode, point out say di stigma na very big issue wey dey face people wey face people wey get vitiligo fo naija and dem no born dem with vitiligo, na as dem dey grow di thing start to dey happen.

Prof. Olasode wey also be Consultant Physician & Dermatologist, Obafemi Awolowo University Teaching Hospitals Complex, yan say vitiligo get link with diabetes mellitus and other endocrine malfunctions.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.