Home As e de hot Naija go reach Universal Health Coverage if… – WHO

Naija go reach Universal Health Coverage if… – WHO

193
0

Representative for di World Health Organisation, Dr. Walter Kazadi-Mulombo, don yan say di way wey Naija go fit reach Universal Health Coverage na to dey support primary healthcare.

Kazadi-Mulombo yan dis one when di Gombe State Governor, Muhammad Inuwa Yahaya, been open di Doma Health Clinic, Jekadafari, Gombe, wey be to help give medical service to people for di area.

WHO yan say diseases and outbreaks wey dey come out for communities na because primary healthcare centres no get enough equipment to help cut am.

Di Commissioner for Health Dr. Habu Dahiru, yan say di facility go help sort out issues wey include Immunisation, safe hospital delivery, nutritional service, and health education.

Governor Yahaya for him own side yan say di facility na part of wetin di government wan use carry health mata close to di poor people and because of that, health facility for di state don change and e don dey upgrade.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.