As di world mark 2022 World Toilet Day, di Lagos State Government reveal say dem build 167 public toilets for some areas for di state and di theme dis year na ‘Sanitation and Groundwater’.
Oga Director of Public Affairs, Ministry of Environment and Water Resources, Kunle Adeshina, for statement wey him release point out say dem also register more than 635 public toilet operators so dem go stop people wey dey shit outside.
World Health Organisation also reveal say like 3.6 billion people for di world no get toilets.
Di Presido, Major General Muhammadu Buhari (retd.), on November 20, 2019, been drop signature for di Executive Order 009 titled, ‘The Open Defecation-Free Nigeria by 2025 and Other Related Matters Order’ so dem go fit stop shit for outside for di country.
For event wey dem do for Lagos Island Local Government Secretariat to mark di day, di Permanent Secretary, Office of Environmental Services, Dr. Tajudeen Gaji, wey send him represent Deputy Director of Sanitation Services, Mrs. Janet Balogun, point out again say di government get di mind to stop shit for outside wey people dey do plus other sanitation problem for di state.