Kwara Government don reveal say dem give immunization to 1.3 million children for July 2022 when dem do Outbreak Response vaccinations for di 16 local government areas for di state.
Di Executive Secretary for di Kwara State Primary Health Care Development Agency, Dr. Nusirat Elelu, open up when dem do Task Force on Immunization Stakeholders Meeting on the state inside Ilorin say di agency go start to dey give di third set for di polio vaccine for November so dem go make sure say di pikin dem dey very safe from di disease.
Elelu point out say di state been get 2 outbreak responses for early 2022 as di disease been bring up him head again we be because of nomads wey dey move around that side.
She still come say 2 local government areas no do full coverage, Patigi still get 42, and Asa get 36 pikin dem wey never collect vaccine and these pikin dem no dey safe against di disease.
Di Executive Secretary promise say di state government stand gidigba to continue dey train and keep healthcare workers especially midwives.