Home As e de hot More naija doctors don collect UK license

More naija doctors don collect UK license

161
0

Di General Medical Council for United Kingdom don give license to fresh doctors wey naija train and e happen for 15days between October 10 and October 25, 2022.

Number of doctors wey naija train but don japa to UK now dey for 10,387 as dem get 5,210 associate specialists, 2,318 doctors in training, 1,837 general practitioners, and 1,273 specialists inside di 10,387 doctors.

As naija dey cry say doctors no dey again and brain drain dey, UK dey give license to doctors wey port from here.

Reports dey show say between January 1, 2022, and September 30, 2022, about 1,307 Nigerian-trained doctors don collect license from di UK but naija doctors wey school or train for abroad no dey inside di count.

As di NMA dey lament on di wahala, dey tok say naija go soon start to dey import doctors and na Nigeria be the 3rd country wey get highest number of foreign doctors wey dey work for UK after India and Pakistan.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.