Home As e de hot Monkeypox na global health emergency – WHO

Monkeypox na global health emergency – WHO

128
0

Di World Health Organisation don yan say dia emergency committee don agree say dem go still put monkeypox for level of global health emergency.

Di health agency been give dia PHEIC wey be día highest level of alarm for July 23rd and even tho some experts tok say dem don dey corner di disease small small, e never reach to announce say e don end.

Chief for WHO, Tedros Adhanom Ghebreyesus, been agree with wetin experts tok.

WHO report yan say since wey Monkeypox start to dey spread for African countries 6 months ago, e don kpai 36 people and more than 77,000 cases don dey for 109 countries.

Di cases outside West Africa dey mostly affect men wey dey knack other men.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.