Home As e de hot Meat wey no done dey cause TB wey worse pass HIV/AIDS –...

Meat wey no done dey cause TB wey worse pass HIV/AIDS – Veterinarian

185
0

One Veterinary Epidemiologist for di National Veterinary Research Institute, Vom, Plateau State, Dr. Muhammad-Bashir Bolajoko, don warn Naija people make dem no dey chop meat wey no done well because e no good for di health and e fit cause tuberculosis.

Bolajoko wey be di Head of the Veterinary Public Health & Preventive Medicine Division for di institute reveal say tuberculosis fit enter human beings from animals if e dey inside di meat already and dey come no cook di meat well.

Banjoko open up say no be just tuberculosis sef, say even some parasitic and bacterial diseases fit enter human being from animal if di person no check or cook him meat well.

Di veterinary doctor still yan say meat and other things wey dey come from animal wey dem get for Abbatoir wey dey anyhow dey always carry one wahala or di other.

Di expert say cows and many other animals fit carry bovine tuberculosis, disease wey dey come because of Mycobacterium bovis, wey be family me ever of di bacteria wey dey cause tuberculosis for human being and e fit enter human being cause TB as di symptoms na fever, night sweats, persistent cough, diarrhoea, weight loss, and abdominal pain.

World Health Organisation for dia side point out say for di world, tuberculosis dey top 10 for things wey dey cause death and naim be di leading cause for one single Infectious agent, e pass HIV/AIDS sef.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.