Home As e de hot Make political aspirants dey do psychia tests – NMA

Make political aspirants dey do psychia tests – NMA

53
0

Di Nigerian Medical Association don yan say make psychiatric evaluation for governorship and presidential candidates wey dey contest for 2023 elections dey because na dia medical results go say whether dia body and mind dey okay enough for di position dem dey hustle for.

Di Chairmo of the National Drug Law Enforcement Agency, Brig. Gen. Buba Marwa (retd.), been cause small wahala for April when he been ask make political parties start to dey add drug tests for dia screening.

Di NMA Presido, Dr. Uche Ojinmah been list tests wey candidates suppose pass to make sure say dem dey fit for mind and body before sem start to dey hustle for position and him say na chest X-ray, cardiac echocardiography, abdominal ultrasound scan, urinalysis, kidney function test, liver function test, blood pressure, blood glucose assessment and even psychiatric evaluation.

Di Presido tok say for di tests, NMA fit set up panel wey go run di medical and psychia tests for dem. could be charged with.

(Punch Healthwise)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.