Home As e de hot Local people need primary healthcare – NPHCDA

Local people need primary healthcare – NPHCDA

128
0

Di Federal Government for di end of di Public Health Care Memorandum of Understanding biannual Partners Review Meeting wey happen inside Abuja, don warn make Zamfara, Jigawa, Kebbi, Katsina, Gombe, Taraba, Niger, and Bayelsa states dey try to dey upgrade target wey dem get to immunise pikin dem.

Di Executive Director for di National Primary Health Care Development Agency, Dr. Faisal Shuaib wey send him represent, Director of PHC Development, Dr. Ngozi Nwosu, don yan say primary health delivery dey importankpa to help local people for di communities by immunisation.

Report show say Gavi been commot $50 million and 13 Toyota Hilux vehicles, and 420 motorcycles to help support 8 states so di healthcare and immunisation go reach deep areas.

Di NPHCDA also tell di states wey benefit from dis mata make dem dey accountable, efficient and dey effective for di way dem dey use di fund and make sure to use di motor wey dem don dash dem to help citizens for dia state.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.