Home As e de hot Lead poisoning dey kill more than 1 million people everywhere – WHO

Lead poisoning dey kill more than 1 million people everywhere – WHO

115
0

Di World Health Organisation don calculate say na almost 1 million people dey die everywhere for di world because of poisoning wey lead dey cause and na more children e dey affect.

Di United Nation’s health agency open up for di International Lead Poisoning Prevention Week say di ones wey no die dey get serious health palava wey dey affect dem for life like anaemia, hypertension, immunotoxicity and toxicity to the reproductive organs.

Dem dey do dis awareness every year so people go fit know wetin lead poisoning be and even countries go know how to tackle am especially for pikin dem. Dia tag dis year na ‘Say no to lead poisoning.’

Experts tok say people dey get dis lead poisoning when lead particles from things wey dem dey burn wey get lead enter dia nose – like when dem dey do smelting, recycling, stripping leaded paint, and using leaded aviation fuel; and ingestion of lead-contaminated dust, water (from leaded pipes) and food (from lead-glazed or lead-soldered containers).

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.