Home As e de hot Late night chop chop dey very dangerous – Scientists

Late night chop chop dey very dangerous – Scientists

108
0

Scientists wey dey Northwestern University, United States, don show reason why e be say late night chop chop no legit as e dey help add weight join diabetes.

Researchers wey study the mata release am for ScienceDaily say people sabi di connection wey chop chop time, sleep and blom blom body get but dem no sabi am.

As scientists take yarn d matter overnutrition fit change circadian tissue (this one dey prepare person body for changes for area like wen sleep don reach and time for enjoyment) and change for fat tissue.

Scientists still open our eyes say energy release fit be the molecular mechanism human being mind dey take control energy balance.

Scientists also yarn say dat time na the right time wey light environment for the earth’s rotation sop dey break down energy as heat.

Dem put am down say things wey dem find out get wide implications from dieting enter sleep loss and as dem take dey feed patients wey need long-term nutritional value.

The person wey study this mata wey be Dr Joseph Bass ,talk say, people sabi Wella, though dem no too understand, say insults wey we dey give the body clock na insult to d way our body dey take break down food to energy wey be Metabolism.

A consultant Pathologist wey be, Dr. Micheal Ajala, don confirm am say person wey dey chop late night ,especially after 7 dey enter danger level mode and the person dey use im health play Koso.

Ajala wey be Chief Executive Officer of Help Diagnostics and Checkup Services, Lagos, don warn say late night chop chop fit secure untimely death for person.

The pathologist don pinpoint late night chop chop na one of the cause for sudden death, as warning dey follow im talk say late night chop chop dey and sleeping almost immediately dey risky.

Im still talk say, make person pikin dey try dey avoid late night chop chop, although the stress wey dey follow work and traffic plenty, say food fit flow back choke person till e kpai.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.