Home As e de hot Lassa fever still dey kpai our people – Bauchi State

Lassa fever still dey kpai our people – Bauchi State

192
0

Di Bauchi State Government reveal say dem don record 16 people wey don kpai from Lassa fever and 130 people wey dem don confam dia infections.

Di Commissioner for Health for di state, Mr. Sabi’u Gwalabe open up for di end of the State Executive Council meeting wey dem do for Bauchi say di state dey record di cases and death since di disease burst out for January till now and the cases wey dem get now dey higher than di ones wey come before.

He come say na areas like Alkaleri, Kirfi, Bauchi andTafawa Balewa wey di disease stand strong dey show dem pepper.

Di Commissioner yan say Bala Mohammed been do big things for heath care like di big equipment wey him buy give 14 general hospitals and primary healthcare facilities for di state and he go still do carry-go for 2 modern primary healthcare centre wey dey Fadamamada and Gida-Dubu inside Bauchi metropolis.

Gwalabe reveal say di government don contribute N100 million counterpart fund to di Basic Healthcare Provision Fund, and dey even shake hand with 200 midwives for contract job for di National Primary Healthcare Gateway so dem go cover di space wey dey because of workers wey no too dey di sector.

For him own side, Alhaji Yahuza Adamu wey be di state Head of Service, yan say di governor don approve N500 million wey dey go use pay gratuities to people wey don retire and make sure say dem pay am because people wey don retire but never collect dia retirement money plenty for di state.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.