Gynaecologist and expert for In Vitro Fertilisation wey base for Akwa Ibom State, Dr. Oladipo Shittu, don stand gidigba say some things wey people think say dey happen to pikin dem wey dem use InVitro Fertilisation born dey normally get mental kolo problem when dem dey develop na lie.
He explain say pikin dem wey dem use IVF born dey very normal and di mental kolo go only happen if di parent get di mata for blood.
Dr. Shittu wey be di Chief Executive Officer of Shelterd’ IVF and Fertility Centre, Uyo, Akwa Ibom State yan for di 2nd anniversary of dia Centre wey dey Oron road, Uyo open up say him no understand why some people for religion dey tok say dem dey try be God for di mata.
Di medical doctor wey also be fellow for di West African College of Surgeons with special training for IVF yan say di belief say e dey ungodly no be true and na help dem dey give women wey no fit carry belle normal.