Home As e de hot Ingredient inside syrup dey kill our pikin dem! – Indonesia

Ingredient inside syrup dey kill our pikin dem! – Indonesia

170
0

Indonesia don yan say children wey don kpai from kidney failure or damage wey connect to things wey dey inside syrup drugs don reach 195 and dem don record more than 320 cases as 27 still dey hospital.

Di Southeast Asia country been notice say di number of people wey dey get acute kidney injury (AKI) don dey increase since August and e make dem open eye come ban liquid medicine.

Reports show say na mostly pikin dem wey never reach 5 years dey affected and di death increase from 133 wey dem confam on October 21.

Di tok tok person for dia health ministry wey be Mohammed Syahril yan say when dem do test, dey see say na mostly syrup wey get excess ethylene glycol and diethylene glycol wey be two things dem dey use for industry to make products like antifreeze and now dem don dey bring in antidote wey go fight di AKI.

Di health ministry still tok say dem don bring on 246 antidote already wey don dey show good sign say e dey work and na mostly Singapore and Australia been dash dem.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.