Home As e de hot Grab di Health Insurance wey govt bring – NBA Presido

Grab di Health Insurance wey govt bring – NBA Presido

240
0

Di Nigerian Bar Association inside Abuja don push dia members make dem grab di health insurance scheme wey di country bring out because e get plenty benefit.

Di NBA Presido, Mr. Yakubu Maikyau, give di advice when him carry other members go visit di Director-General for di National Health Insurance Authority, Prof. Mohammed Sambo, say di association don check everything wey dey di National Health Insurance Act and dem see say e nice well well.

Maikyau still twale give Mr. Olumide Apata, we been stand up before him take over as Presido say him do well as na him start di waka to put di health insurance scheme for members wey dey NBA.

Di presido open up say NBA get better relationship withdi agency wey Apata bring in and him go maker sure say he hold di collabo well because e dey help di two groups.

Maikyau come still beg make di country Presido, Muhammadu Buhari helep di NHIA for funding because di agency need serious funding so dem go fit do dia work.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.