Di Gombe State Government don open hand collect di relief materials wey di National Emergency Management Agency bring for people wey survive cholera for di state.
Dem give di things to di Government for di Primary Health Care Centre, Tudun-Wada, Gombe for di ceremony wey di Deputy Governor, Dr. Manassah Jatau, been represent Governor Muhammadu Yahaya.
Di Governor collect di items come later give some survivors there so people go see before dey start to dey share di other ones as him direct di officials.
Yahaya before di presentation been thank di Federal Government of Nigeria and the National Emergency Management Agency say dem come to help divictims wey cholera affect.
Di Represent for di Director-General National Emergency Management Agency, Mustapha Ahmed, yan say di items na to commot di suffering wey survivors for cholera dey face for di nation and he list di items wey dem bring as 39 cartons each of Dettol, Izal, and bleach, 800 packets of detergents, and 1000 pieces each of blankets, mattresses, plastic buckets, spoons, and pieces of mosquito nets and plenty others.He come beg make di officials make sure say dem share di items well to di right people wey need am.
Di Executive Secretary, Gombe State Primary Healthcare Development Agency, Dr. Shuaibu Abdulrahaman wey Dr. Maryam Abubakar represent yan say di state been suffer outbreak of cholera seven local Government Areas and e affect 663 people come kpai 16 people.