One Consultant Neurosurgeon with Brain and Spine Surgery Consortium for Abuja, Dr. Biodun Ogungbo, tok on Wednesday say dem get plans to do one conference wey dem call ‘Doctors for Change’, so dem go fit boost healthcare for di country.
Ogungbo yan say conference wey go happen for November 19, inside Lagos go be chance for all di doctors to join hands for change so dem go get better way to upgrade di Healthcare system for Naija.
Ogungbo point out say when coro been attack, DFC been gather money wey dem use buy plenty Personal Protective Equipment.
He yan say dem share di PPE to hospitals we dey di country so dem fit help government for wetin dem dey do.
(NAN)