Di Chief Medical Director for University College Hospital, Ibadan, Prof. Abiodun Otegbayo, don dey cry say make government comot blockade wey no dey gree dem replace health workers as plenty of dem dey japa comot for di country.
Otegbayo been yan dis one for news conference when dem do 65th Founder’s Day celebration for di foremost tertiary health institution inside Ibadan.
He yan stay d etu week him dey collect 15 resignation letter for health workers wey be nurses, doctors, and pharmacists, and plenty others.
Otegbayo still reveal say from 2020 to October 15, 2022, more than 600 health workers don japa comot from the hospital and blockades no gree dem replace di workers.