Home As e de hot Diabetes need intervention to reduce – Prof

Diabetes need intervention to reduce – Prof

159
0

One Prof for Medicine and Consultant Endocrinologist for Obafemi Awolowo University, Ile Ife, Prof. Babatope Kolawole, dey beg make better intervention dey so e go help reduce number of people wey dey get diabetes, especially for Africa.

Kolawole yan say diabetes cases dey increase because dem never dey do things wey dem suppose do to cut am down so make dem find way to bget resources so dey go fit dey do screening to find out the serious chronic cases.

Di Prof yan for lecture wey dem title, ‘Achieving diabetes prevention through education’ wey him give for di Afe Babalola University, Ado Ekiti, to mark di 2022 World Diabetes Day say na more awareness dem need to fit prevent diabetes because by 2045, people wey get diabetes go increase reach 784 million people.

Di Chancellor for ABUAD, Aare Afe Babalola SAN, beg make researchers wey dey di school start to dey work dey find cure for diabetes wey dem don show say nah silent killer.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.