Home As e de hot Dey check for cancer on time! E fit save you – Pfizer

Dey check for cancer on time! E fit save you – Pfizer

146
0

Pfizer don advise people make dem dey shine dia eyes to dey check for cancer on time and also to dey tell family and friends make dem dey do plenty self-examination.

Pfizer tell health people for dia virtual Media Roundtable wey dem do to mark Breast Cancer Awareness Month make dem get ways wey dem go take dey relate with patients about things like cancer and also dey support dem.

One Medical Director, East and Anglo West Africa, Kodjo Soroh, yan say Oncology na way wey dem dey use for therapy field for Pfizer as dem dey work to make sure say dem achieve big things for medicine wey go change lives of patients for dia région especially and dem dey proud of wetin dem don do.

One Consultant Clinical and Radiation Oncologist, NSIA-LUTH Cancer Center, Lagos University Teaching Hospital, Lagos, Nigeria, Dr. Adewumi Alabi, come yan say e dey very importankpa to continue clinic research on how dem go run breast cancer care.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.