Home As e de hot Declare state of emergency for health – Ogun NMA

Declare state of emergency for health – Ogun NMA

111
0

Di Nigerian Medical Association for Ogun State don ask make dia state government declare state of emergency for health sector so dem go fit clear di brain drain wey dey occur.

Di NMA Chairmo for di state wey be Dr. Adekunle Ashimi yan dis one when dem do di 2022 Physicians’ Week wey dem tag ‘Nigeria’s Healthcare Delivery System and the 2023 Democratic Transition: A Time to Change the Narrative.’

Ashimi say e pain am say brain drain just dey use di health sector play ball and dat more than 10,296 doctors wey go school collect dia certificate from Naija don japa to di UK to work and na Naija get highest number for doctors wey dey work for UK after Pakistan and India.

He yan say dis dey make di country go down for level of human resource and if di government no declare state of emergency for health, di mata go continue.

Ashimi also beg make government look into di mata of di Consolidated Medical Salary Scheme so hazard allowi for health worers go dey uniform and dem go pay am sharp sharp.

(NAN)

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.