Home As e de hot Declare state of emergency for health! – NMA to govt

Declare state of emergency for health! – NMA to govt

165
0

Di Nigeria Medical Association don tell government make dem on Monday for Ilorin say make dem declare state of emergency for di health sector.

Di Kwara Chairmo for NMA, Dr. Abdulkadir Ahmed, been yan as dem dey mark di 2022 Physician Week say dem dey lose human resources for health and still gats dey alert to fight Lassa Viral Haemorrhagic fever, Malaria, COVID-19, Ebola, Marburg, and plenty others.

He point out say in order make dem save di people, government gats do more and make dem declare state of emergency for health asap.

He also yan say even tho di doctors get plenty problems, dem dey celebrate say dem dey alive at least.

Ahmed open up say NMA Kwara members don record plenty success for career development as dem pass dia fellowship examinations, come get promotion to level of Professors and Associate Professors and at least 5 NMA members wey come from di state don reach NMA National offices.

Di NMA chairmo still open up say di excess flood wey dey happen for di country dey pain am well and make government for all levels help di victims and also find way to stop di flooding kpata kpata.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.