Di World Health Organisation don reveal say di COVID-19 vaccination coverage don pause for half of di African countries as di number of doses wey de dey give for di months don drop by more than 50percent from July reach September.
Di analysis report show say di percentage of people wey don get complete vaccination never shift from one spot for 27 inside 54 african countries for 2 months now (from 17 August – 16 October 2022).
Inside September na 23 million doses dem give and e dey 18 percent less than di number wey dem register for August and 51 percent less tha 47 million doses dem give for July.
Even with dis setback, WHO reveal say small progress don dey for di vaccination of high risk groups like di elderly groups.
WHO still reveal say Liberia don join Mauritius and Seychelles as one of 3 countries wey don pass full coverage as dem don give more than 70 percent of dia population full vaccination and Rwanda too don almost reach dis level.