Home As e de hot Coro still hol China for neck

Coro still hol China for neck

215
0

China don report 2 death for older people wey coro cause inside Beijing on Monday as major cities for di country still use strong hand keep di lockdown and anti-coro instructions.

Since wey Coro jam China, hold dem for neck, di authorities don dey use red hand put snap lockdowns, mass testing and lengthy quarantines so dem go fit cut the outbreak wey dey come.

Di people wey kpai na one 91-year-old woman wey been get history of stroke and Alzheimer’s disease, and one 88-year-old man wey get history of cancer, bronchitis and stroke. Cases jump from 621 to 962 in one day and authorities don stand gidigba dey try cover up di areas wey dey weak wey dey make di cases come out.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.